Hero lyrics by Tim Godfrey (Mp3)

Hero lyrics (Mp3) 


Wetin i for do who i for call o
If e no be you how i for run o
Baba o, na you rescue me e e e
No money for pocket,
No food to eat,
My shoe na so so alignment, no house to
Sleep,
You come rescue me,
That's why you be my hero

Oh na only you be my Hero
Na on only you i go follow
Why you love me so...
Even when i don loose hope
Everybody give me long rope
You come rescue me
That's why you be my hero oh

2.
Na so dem dey call me mumu
Their mouth dey chop me like fufu
Dem yab, dem laugh me, reject me, eject me,
Dem even say i no go school,
Thank you baba u no dey look face, thank you
Baba you no get two face, na you rescue me
That's why you be my hero.

Bridge 1.
I dey lonely, only me,
You come love me
Come lift me
My spirit, my soul take control, my heart and
My love
My hero oh.oh.my hero

Brigde2.
When dem reject me, eject me, dem wound
Me, dem wan kpai me, dem no know say na
Because of you i still dey o!

Na only be my hero
Na only you i go follow. 
 

Post a Comment

0 Comments